Episode 18
THE " the " DAY "!"
As next day reach like this, na around 5am i don wake up. i no kukuma see the sleep sleep like that self .I see say he be like say morning never reach well, make i chill small.i go sleep back.
By the time wey 8 go knack, i don wake up. I wan use the Close up tooth paste .I see say he don finish .I use knife cut am into two.use the one wey remain inside brush mouth well.All the inner and all those corner corner teeth na hin i wash well as i no pity the Tongue sef.
I scrape the thing wella make i no con wan day kiss , make mouth day smell. After i finish The small close up, i con use the other Oral B toothpaste wey i get, use am brush mouth again. If one toothpaste no work , d other go work.
After i brush finish.i used sponge and Dudu osun to scrub away every impunity and dirty dirty wey day for my body. Na almost 1 hour spend for bathroom. Any place wey i fit Scrub na hin i scrub. As i day scrub, dey baff, na hin i day sing Reminisce Tesojue laleyi, wafe Ku laleyi
Infact na the kind baff wey person wey day baff am go sabi say the baff wey hin day baff pass oda baff wey hin don dey baff before .
I shaved all the hair wey dey my body comot, both upper and lower region. Anything fit shele anytime, wey she go feel like licking the Stick sweet .
She fit go vex comot if na Mangroove Forest she go meet for there, i make sure say everything, clear like Sahara desert. Na Reflex action .
Time no day today, i get plenty things i must get sharpaly .as soon as possible.
I sharply go bank atm. i go withdraw the last 7 thousand 500 naira wey remain for the account. One guy wey day beg for transport fare go hin village, though nobody give am any money. i comot 500 wey day top, give the guy.
From there, i comot go market.
The First thing wey i bin buy na flowers, I buy flowers, I buy this poster abi na banner wey dem day put for wall for inside house
I specifically make sure say na the one wey dem day kiss and romance and half Unclad ladies in bikinis day na hin i buy. i buy 3 of that one.
I buy air freshener and better perfume, i buy hanger to arrange all my clothes wey i be no arrange and i buy Foot mat wey i go put for door as i bin no get any before.
After i reach house, i go Mama Peter Store, buy Viagra and two bottles of alomo. con use one leg branch iya shakira alagbo, na there i con buy 200 naira worth aleto, opa eyin.jedi jedi and Ato pa.
After i buy all this.i go Abigurl and Prettyjo pharmaceutical store and supermarket, go buy condom. Make she no day dey reason me cheap or local, i buy Original Durex condom. .
He be like set everything don day set small small.
What of the rice wey she wan chop ?? I hustle go market back . Be like say I get rice for house, I just go buy fish. small meat, tomato, Maggi, ponmo and the rest wey i go use sama the girl better jollof rice. i just day sweat day pespire as i bin day jump from one okada to another.
Na there i meet one of my old padis, Edgyslim.
We greet. talk small and he talk say make he con sabi my house , say he get one big business way he wan involve me.
Today? oloshi. He no con fix better time, na, around 6 and 7 the (((Abusive word Blocked))) go fix again. Destiny destroyer, by the time wey my guy go talk say make he carry wetin hin buy and comot phone collect my number, i don tear comot.